Home NEWS Who Dey Giv Us Dis Kain Leada Dem?

Who Dey Giv Us Dis Kain Leada Dem?

0
379

Steve Bode

We dey always talk one thing

wey I no undastand.

We dey always talk am say:

‘Na God dey giv pipo leada’

Pastor dey always tell us say

make we dey pray for awa leada dem

and Imam dey talk am say

make we dey obey awa leada

bikos na God choose dem for us.

Di thing dey do me biribiri for eye’o.

So, I wan ask una some kwueshon:

How we go dey obey and pray

for awa leada when ih clear

for awa eye say dem wicked

pass Devil sef and im angels?

If na God dey giv us dis leada dem

why ih bi say dem wicked like dis

so tay so tay so tay dem dey rape

their own mama and their papa wife

for public from republic to republic?

Wait’o, you sure say na

Allah giv us Tarewa Babewa?

Na God giv us Agihinosi dat year?

Na God bring Ogorwon and Okuku

wey fight war kill pipo berekete?

Na Allah bring Amedu Atalamuri?

Na God still raise Shika Biika kill am?

Na God bring Egbasanjo dat time?

Na Allah replace am with Heu Nagari

kom komot am put Onamad Nuhari?

Na Allah let Badnagida komot Nuhari

Kom step am aside for Shomicorn?

wey Akpani Achaba komot?

Na Allah bring Abdu-na- Alarm

Na God giv us Egbasanjo again

wey go bring Yeah Na Doer

wey sickness no let am do us betta?

Na God giv us Jona Boo-Luck

Wey we vote komot as Badluck?

Na Allah replace am second time

with retired General Nuhari

wey promise us Boomharism

kom change am to Doomharism?

How God wey love us with all im bele,

God wey giv us everything free

kom curse us with dis kain leadas?

As dem dey come, dey go, dey die

Na so dem dey worse put

Ah, ah! I bow! Ih taya me’ o!

So, which one God wan giv us now

from dis chimp, gorilla and ape dem

wey dey wear over-size agbada

over-long dansiki & babaringa

Wey dem dey use pack dirty & mud

to advatise boju-boju manifesto

wey dem don mix with fake honey?

Fear dey catch me’ o! I swear!

Fear dey dey catch me wel-wel

No do no do, as we no dey send,

anoda Mess-ziah go kom

turn dis Doomharism now

to di Boomharism of 2015 to 2023,

as Doomhari do di one we call Badluck!

You dey say tufiakwa or Oloun ma je?

Walahi talahi, ih go shock you!

Na so we go dey speak gramma

with oyinbo nose accent, dey write

dey look, dey snore on top of sleep

Troway awa fate to spoilitician dem:

Pipo wey no get heart and joy

Blood-sucking  demon dem!

Afta eleshon, dem go settle down

pour raw acid from America

for awa private part and face,

turn awa garri to sand-sand

giv us paint wey dem make for UK

to soak and drink am by force!

Wetin remain again wey dem

don kuku blind us with acid?

bode.ekundayo@uniben.edu

NO COMMENTS